Wikipedia pcmwiki https://pcm.wikipedia.org/wiki/Main_Pej MediaWiki 1.45.0-wmf.7 first-letter Media Impotant Tok abaut am Yuza Yuza tok abaut am Wikipedia Wikipedia tok abaut am File File tok abaut am MediaWiki MediaWiki tok abaut am Templet Templet tok abaut am Hep Hep tok abaut am Katigori Katigori tok abaut am TimedText TimedText talk Modul Modul tok abaut am Yemisi Ransome-Kuti 0 3032 32847 31849 2025-06-25T21:45:29Z InternetArchiveBot 52 Rescuing 1 sources and tagging 0 as dead.) #IABot (v2.0.9.5 32847 wikitext text/x-wiki '''Yemisi Ransome-Kuti''' na [[Naija]] aktivist wey don fait wel-wel for civil sosaiti and gel-pikin edukeshon. Shi bi faunda of Nigerian Network of Non-Governmental Organizations (NNNGO). Shi bi onli pikin of Azariah Olusegun Ransome-Kuti, wey be Chief Pharmacist for Naija from 1956. Na King George VI giv am MBE taitul for 1951. Yemisi na gel-pikin-pikin of Rev. Canon Josiah Ransome-Kuti, and ha anti Chief Funmilayo Ransome-Kuti na strong feminist wey ivun folo go beg British pipul for Naija independence.<ref name="auto">{{cite web|url=https://www.theguardian.com/lifeandstyle/2010/dec/11/fela-kuti-great-dynasties-ian-sansom|title=Great Dynasties: The Ransome-Kutis|first=Ian|last=Sansom|date=11 December 2010|access-date=2025-04-24|website=Theguardian.com}}</ref> Shi stil bi kosin to Fela Kuti, Beko Ransome-Kuti, Olikoye Kuti, and Wole Soyinka (wey bi fest Afrika pesin wey win Nobel Prize for Literature). Nau wey dem don kpai, Yemisi na di hed of di Ransome-Kuti famili. She get four pikin: Segun Bucknor, from ha fest hosband Naval Captain Frederick Oluwole Bucknor (wey don kpai), den Bola, Seun, and Eniola Soyemi, from her sekond hosband, Dr. Kunle Soyemi. For eli 1990s, shi stat "Girl Watch", to help tren and eduket pwo gels for Naija. Shi stat NNNGO for 1992, wey na fest kaind of NGO netwok for Naija. Dem dey bring NGOs togeda to wok as one vois for beta divelopment.<ref name="Moore2011">{{cite book|author=Carlos Moore|title=Fela: This Bitch of A Life|url=https://books.google.com/books?id=_iqFZuXyK_4C&pg=PT18|date=1 August 2011|publisher=Omnibus Press|isbn=978-0-85712-589-7|page=18}}</ref> For 2006, World Bank chuz ha as Civil Society Advisor. Shi join pipul wey dey push mek Naija rich Millennium Development Goals and end povati.<ref>{{cite web|url=http://feminine.com.ng/2016/07/22/yemisi-ransome-kuti-can-die-fighting-injustice/|title=Yemisi Ransome-Kuti can die fighting injustice|last=Kate|date=22 July 2016|website=Feminine.com.ng|access-date=2025-04-24|archive-date=2017-12-04|archive-url=https://web.archive.org/web/20171204222952/http://feminine.com.ng/2016/07/22/yemisi-ransome-kuti-can-die-fighting-injustice/|url-status=dead}}</ref> ==Awod wey dem giv am== For 28 May 2022, shi win Outstanding Intellectual of the Year Award from Women of Inestimable Values Foundation for Lagos.<ref>{{cite web |last=TheVanguardNgr |first=VanguardNewsNgr |date=2 June 2022 |title=WIV IMPACT AWARD |url=https://vanguardngr.com |website=Vanguard}}</ref> ==Wia dem gada di tori== {{Reflist}} [[Katigori:Naija pipul]] [[Katigori:Naija wuman]] [[Katigori:Tori abaut pipul life]] if1ygenu6ieydj0jontdkmwoinydwle Adenike Adebukola Akinsemolu 0 3095 32845 32823 2025-06-25T13:42:07Z Jonywikis 29 32845 wikitext text/x-wiki {{Databox}} '''Adenike Adebukola Akinsemolu''' na pesin wey dey faight for beta way wey we go tek kip our environment kleen an beta for future. Shi bi ticha, raita, and pesin wey dey du biznes to hep society. Shi dey tich for Obafemi Awolowo University (Adeyemi College Campus). Pipu sabi her wel wel as one of di oga dem for Nigeria wey sabi environmental sustainability (di way wey we fit tek liv weyno go spoil di environment). ==Wok wey shi don do== Akinsemolu na di pesin wey stat Green Campus Initiative, wey leta turn to Green Institute. Shi stil stat one program wey dem kol Girl Prize, wey dey hep yung secondary skul girls for Nigeria wit money an mentorship to push dem forward. ==How shi wok== Adenike Akinsemolu na Ondo State shi fom come. Shi go skul for Babcock University an Federal University of Technology, wia shi kolet Master's an Ph.D for Environmental Microbiology. Shi stil do one extra program for education for Obafemi Awolowo University. Shi don wok wit Clinton Foundation for New York bifor shi kom bak Nigeria kom stat Green Campus Initiative. Shi bi Associate Fellow for Royal Commonwealth Society an shi dey among di pipu wey dey lead Sustainable Energy Practitioners Association of Nigeria (SEPAN) onda Ministri of Power. In 2015, shi win Nigeria Energy Awods for di wok wey shi do on energy efficiency and awareness. Shi dey holways tok sey mek dem put green education an sustainability for Nigerian school curriculum. Shi dey wok wit United Nations Sustainable Development Solutions Network, an shi bi Scientific Committee Member for di 6th Annual International Conference on Sustainable Development (ICSD) for Columbia University. For 2020, shi rait one buk wey dem kol "The Principles of Green and Sustainability Science," wey explain different wahala wey dey afect sustainability for Afrika. For March 2021, dem recognize ha as one of di best young leaders for Africa wey dey faight for environment protection. She win Africa’s Top 100 Young Conservation Leaders awod fom difren international organizations. ==Green Institute== For 2015, Akinsemolu start Green Campus Initiative (GCI), di first university-based environmental advocacy organization for Nigeria. E get awod for South Africa bikos of di gud wok wey dem dey do for university campuses. For 2016, GCI turn to Green Institute, wey bi skul an research center for sustainability. Profesor Damilola S. Olawuyi bi di first president of di institute. Di school dey tich pipu how to tek care of di environment an how dem fit stat business wey go hep society. Di institute bi bi di first school for Nigeria wey dey hep students pay skul fees wit waste management program wey dem kol "Trash for Education." Di program dey mek students kari waste kom, kolet points, an uze am pay school fees. Na di stet govment an private kompanies dey buy di waste. 47zibnk21vsyfagr8se74edpq3wzbec 32846 32845 2025-06-25T13:42:39Z Jonywikis 29 32846 wikitext text/x-wiki {{Databox}} '''Adenike Adebukola Akinsemolu''' na pesin wey dey faight for beta way wey we go tek kip our environment kleen an beta for future. Shi bi ticha, raita, and pesin wey dey du biznes to hep society. Shi dey tich for Obafemi Awolowo University (Adeyemi College Campus). Pipu sabi her wel wel as one of di oga dem for Nigeria wey sabi environmental sustainability (di way wey we fit tek liv weyno go spoil di environment). ==Wok wey shi don do== Akinsemolu na di pesin wey stat Green Campus Initiative, wey leta turn to Green Institute. Shi stil stat one program wey dem kol Girl Prize, wey dey hep yung secondary skul girls for Nigeria wit money an mentorship to push dem forward. ==How shi wok== Adenike Akinsemolu na Ondo State shi fom come. Shi go skul for Babcock University an Federal University of Technology, wia shi kolet Master's an Ph.D for Environmental Microbiology. Shi stil do one extra program for education for Obafemi Awolowo University. Shi don wok wit Clinton Foundation for New York bifor shi kom bak Nigeria kom stat Green Campus Initiative. Shi bi Associate Fellow for Royal Commonwealth Society an shi dey among di pipu wey dey lead Sustainable Energy Practitioners Association of Nigeria (SEPAN) onda Ministri of Power. In 2015, shi win Nigeria Energy Awods for di wok wey shi do on energy efficiency and awareness. Shi dey holways tok sey mek dem put green education an sustainability for Nigerian school curriculum. Shi dey wok wit United Nations Sustainable Development Solutions Network, an shi bi Scientific Committee Member for di 6th Annual International Conference on Sustainable Development (ICSD) for Columbia University. For 2020, shi rait one buk wey dem kol "The Principles of Green and Sustainability Science," wey explain different wahala wey dey afect sustainability for Afrika. For March 2021, dem recognize ha as one of di best young leaders for Africa wey dey faight for environment protection. She win Africa’s Top 100 Young Conservation Leaders awod fom difren international organizations. ==Green Institute== For 2015, Akinsemolu start Green Campus Initiative (GCI), di first university-based environmental advocacy organization for Nigeria. E get awod for South Africa bikos of di gud wok wey dem dey do for university campuses. For 2016, GCI turn to Green Institute, wey bi skul an research center for sustainability. Profesor Damilola S. Olawuyi bi di first president of di institute. Di school dey tich pipu how to tek care of di environment an how dem fit stat business wey go hep society. Di institute bi bi di first school for Nigeria wey dey hep students pay skul fees wit waste management program wey dem kol "Trash for Education." Di program dey mek students kari waste kom, kolet points, an uze am pay school fees. Na di stet govment an private kompanies dey buy di waste. For June 2020, di institute organize one big Global Sustainability Summit on World Environment Day (5 June). More dan 25 sustainability leaders fom difren kontries join, including one oga for ekonomi an environment, Jeffrey Sachs. nd54bkqoy329wplppp550zgor8dctmm